jaayy avatar

NAIJA PIDGIN CHALLENGE: ADDING THE BLOCK BUTTON TO THE STEEM SOCIAL NETWORK.

jaayy

Published: 09 Feb 2018 › Updated: 09 Feb 2018NAIJA PIDGIN CHALLENGE: ADDING THE BLOCK BUTTON TO THE STEEM SOCIAL NETWORK.

NAIJA PIDGIN CHALLENGE: ADDING THE BLOCK BUTTON TO THE STEEM SOCIAL NETWORK.

IMG_20180209_161502_243.jpgI don come again oh. This na naija pidgin challenge wey ogoowinner@ogoowinner don arrange for us.
For this one so, the tori wey dey on ground now na whether this our ogbonge steemit need block button.

My own talk inside this matter na say we need block button oh. I agree with ogoowinner@ogoowinner well well. We need am because bad belle people full everywhere. Some kain yeye people go dey write yeye comment ontop your post and e no get anything wey you go fit do about am. That kain thing no good at all.
At least if block button dey now you go fit block dem make dem no dey fit see your post again.
We even need delete button join sef so that we go fit dey delete all those yama yama comments dem.
That one na my own talk inside this matter oh.
Shout-out to ogoowinner@ogoowinner. You strong well well.

The picture wey I put so na picture of one better naija actor wey I dey sure say all of us sabi well well. E name na Pete Edochie.

Leave NAIJA PIDGIN CHALLENGE: ADDING THE BLOCK BUTTON TO THE STEEM SOCIAL NETWORK. to:

Written by

Read more #npc posts


Best Posts From jaayy

We have not curated any of jaayy's posts yet. But you can encourage our curation team to review posts by visiting them regularly and by referring other readers. Because we give priority to frequently read content.

More Posts From jaayy