Sir.steve avatar

nigerian pigin challenge

sir.steve

Published: 01 Feb 2018 › Updated: 01 Feb 2018nigerian pigin challenge

nigerian pigin challenge

I believe say everybody get the right to be seen, heard and loved.
I believe say all human beings dey eqaul.
I believe say the world dey big enough to accommodate all of us.
I believe say everybody say e get that one thing wey each person sabi do.
I believe say everybody dey different from each other in one unique way or the other.
I believe say everybody get in own beast and angel wey dey inside am, so na to keep the beast on the low and try dey
show that angel part.
I believe say race, religion and social status na nothing but the creation of kata kata men to use control others,na in dey cause strife the in-plant supremacy mentality. so me i choose to be "human first" before i fit be any race or religion or class.
I go do people wey thing me i go like make them do for me.
I no go relate with people based on who them be but based on wey thing i want make them become
I no go do business wey go bring problem for another man.
I go try understand people instead of to judge them.
I no go allow envy, jealousy and envy to control my motives.
I go make sure say i achieve one better thing for humanity before i commot for this earth.
I go try dey strong even for the face of misfortune, grieves and sorrows.
I no go allow fear intimidate me.
I no go allow any negative thought get space for my mind, i go replace am sharp sharp with peace and creative thoughts as soon as them come because i know say thoughts get power.
I go always dey my original self and not to photocopy another person.
I believe say i fit make difference if i put in my best to any given task.
Iibu-320x220.png believe say life na journey instead of race, i no go allow myself go into competition with anybody.
I believe in peace
I believe in charity
I believe in forgiveness
I believe in love
I believe in mercy
I believe in justice for all
I believe in human race
I make the decision to "live" and no be to merely "exist"
I Sir.steve go abide by this creed all the day of my life.

Leave nigerian pigin challenge to:

Written by

A student at the university of Port Harcourt

Read more #npc posts


Best Posts From Sir.steve

We have not curated any of sir.steve's posts yet. But you can encourage our curation team to review posts by visiting them regularly and by referring other readers. Because we give priority to frequently read content.

More Posts From Sir.steve