Friendly enemy and dia wahala
Weldone @ogoowinner for this correct topic, I no sabi talk to much sha but I go just jump enter the matter way day ground.
This one happen to me just last year ooo when I been wan do I.T, My formal roommate way we part ways in peace kon turn secret enemy oo just stay corner day hate.
I suppose do the I.T for ph for one interior decoration office and my roommate sabi the Owner well well. So I kon take permission from him say I wan do the I.T dia if him day okay with am, he say yes make I continue but for my back him day busy day call my boss to fire me. Every single day him go call my boss they tell am all kind of yeye talk about me, SACK THAT BOY, SACK THAT OLE, SACK HIM, SACK HIM, My boss kon call me begin ask me wetin day happen, if we day fight I tell am No, I even kon call my friend for him front, as usual he pretend like one nice friend we talk better laff wella. Then him Kom call am put am for speaker , My ppl una need day dia hear wetin this my friend open mouth day vomit. I no even know when tears just begin pour for my eyes.
Make I just stop here sha, cause this matter just too heavy for mouth.
My ppl make una day careful biko, cause friendly enemies no be here ooo.
Leave Friendly enemy and dia wahala to:
Read more #npc posts
Best Posts From Banks
We have not curated any of phuresh's posts yet. But you can encourage our curation team to review posts by visiting them regularly and by referring other readers. Because we give priority to frequently read content.
More Posts From Banks
- Heard
- Steemit And Utopian.io Awareness In Philippines, Ghana And India - Website/Blog Posts and Social Media Ads
- CREED OF LIFE- FACTS WE STILL TEND TO HIDE
- Steemit Poetry Contest #13 -Shattered Coven
- Friendly enemy and dia wahala
- An Amazing Contest by @mimy (No Dare Just Truth)
- Why 500 SP should be delegated to me
- Steemit poetry Contest #11 - Behind A Mask
- Paragon
- Steem poetry Contest #8 Life is an Illusion