The Fun, Vibes and Madness of O.A.U Student Life
My brother and my sister greetings to all of una,If you never go Obafemi Awolowo University (O.A.U), I must talk say you dey miss o, That school no dey dull at all. Forget say na book dey worry us sometimes, O.A.U life full of vibes, enjoyment and memories wey no fit leave my head till now.
The sports events is always lit, Anytime O.A.U dey do sports festival, the whole campus go just dey hot like fire. Football matches Omo, na war be that one Faculties go dey drag like say World Cup dey happen for Ife. Athletics, basketball, volleyball, even table tennis dey carry their own crowd. Everybody dey rep their department with full ginger. And on top say me self I be football I always dey feel happy, great and proud of myself like when dey cheer us up with singing of all sports song, drumming and dancing. The pitch go full of crowd even those wey no love football go come watch.
Then we get S.U.G week. Cha That one na another level of enjoyment. From Monday reach Sunday, na back to back activities. Sometimes dem go invite special guest speakers wey go delivered better motivational talks for students. Other days, na concert, dance, debate, or drama. The campus go just dey bubble like say na carnival. I fit say na carnival cruise cos every where dey colourful DJs go dey every places under trees , resting and refreshment centre,n na every place in the school dey bubble.
My favorite memory na that school choir singing competition from the music department. Omo those people sabi sing die una voices go just dey sweet ear like honey, and people go dey clap anyhow. Some of us no even sabi sing but we go still shout from back like backup singers.
And person no fit forget about the rag day? That one na cruise of life, full of madness, Students go dress anyhow one go wear slippers for hand, another go put plate for head like cap. People go dey beg for money with steeze, but all na cruise I swear, if you no laugh that day, then you no be human being.
Then there’s the talent display show that events na where students show wetin dem sabi from dance to spoken word, comedy, even magic tricks. O.A.U students too get talent! And of course, the final year party. That one dey always make forget say then be student, then dey turn to party dancers. Last dance, last groove before serious adulting go catch everybody.
To be honest, O.A.U no dey boring at all at all oo. My school days full of laughter, events, noise, and gist wey I no fit forget. Anytime I remember am, I just dey smile. Na real sweet memories.
Images are mine
https://vote.hive.uno/@thebbhproject
https://vote.hive.uno/@hivecuba
Support the witness and vote for TheBbhProject carried out by @bradleyarrow
Leave The Fun, Vibes and Madness of O.A.U Student Life to:
Read more #hive-109584 posts
Best Posts From Davingson
We have not curated any of davingson's posts yet. But you can encourage our curation team to review posts by visiting them regularly and by referring other readers. Because we give priority to frequently read content.
More Posts From Davingson
- Being Kind Is Not the Same as Being Weak, It Just Looks That Way to Certain People
- The Things I Worried About Most Never Happened the Way I Feared They Would
- I Stopped Needing The Last Word And My Relationship Got Better
- There Is a Version of You That Would Be Ashamed of How Little You Bet on Yourself
- Forgive Yourself First, Everything Else Becomes Easier After That
- Nobody Actually Has Life Figured Out, Some People Are Just More Comfortable With Uncertainty
- I Wasted Years Trying to Change People Who Did Not Want to Change
- The Relationship That Taught Me the Most Was the One That Hurt the Most
- The Older I Get the More I Understand How Short This Actually Is
- I Spent Years Waiting for Permission to Start