queendiva avatar

my introductory Post in pidgin

queendiva

Published: 25 Jan 2018 › Updated: 25 Jan 2018my introductory Post in pidgin

my introductory Post in pidgin

Hello everyone, I will be introducing myself with pigin. I just want to be and express myself in a way I feel more comfortable with.

FB_IMG_1516256439716.jpg

First of all make I greet una my country people for steemit. E dey sweet me say today I dey do am dey naija way.

My name na Queen, I be better Akwa Ibom girl. As e dey so now I dey study microbiology for University of Uyo and I be the last pikin were my papa and mama get.

FB_IMG_1516256412020.jpg

I sabi play drums and football o (no try me, I go dribble you 😂).I the believe say steemit go give me that chance make I showcase waiting I get.

Na my friend enajo@enajo been yarn me about steemit. Since I know that guy, Na the first better thing him don carry come my way. enajo@enajo I salute you, your girl still dey loyal.

I also throw-say salute give aunty ogoowinner@ogoowinner for wanting she dey do for us for steemit. I pray say one day I go fit see am eye to eye. I also throw-way salute give daddy ejemai@ejemai, him too much. If no be because of am I no know where I for dey. God bless you ejemai@ejemai.

Finally my plan for this steemit for now (I no know as e go be for future), Na to contribute better better things to this community, make money, and then dey enjoy myself as I dey do this things......

Leave my introductory Post in pidgin to:

Written by

Read more #introduceyourself posts


Best Posts From queendiva

We have not curated any of queendiva's posts yet. But you can encourage our curation team to review posts by visiting them regularly and by referring other readers. Because we give priority to frequently read content.

More Posts From queendiva