Ojowayne avatar

Ronaldo still a headmaster

joeojo27

Published: 08 Aug 2023 โ€บ Updated: 08 Aug 2023Ronaldo still a headmaster

Ronaldo still a headmaster

FB_IMG_1691493539585.jpg

Ronaldo don do wonders for Al Nassr 2 days ago and I dey hear say Al Nassr fans won go release better song for Ronaldo because Ororo save dem today.๐Ÿ˜‹๐Ÿ˜‹

Zamalek bin dey lead Al Nassr 1 - 0 around 53' mins and if the match end like that Al Nassr go commot for Arab Cub Champions cup competition.๐Ÿ˜ช๐Ÿ˜ช

60'mins, goal no gree come, Al Nassr fans begin dey pray some begin dey touch their jazz yet goal still no gree come, 70 mins, goal never come some Al Nassr fans begin dey go house small small with tears.๐Ÿ˜ช

Around 87'mins, Ronaldo see say fans don dey go small small naso Ororo activate e inner Ronaldo skills come jump score better header wey help Al Nassr equalize 1-1.

As it stands, Al Nassr and Al-Shabab don qualify for group C and Ronaldo don score 16 goals in 21 games for Al Nassr.

FB_IMG_1691493547176.jpg

Abeg make we congratulate Ronaldo and Al Nassr.

Leave Ronaldo still a headmaster to:

Written by

Scientist

Read more #hivesnaija posts


Best Posts From Ojowayne

We have not curated any of joeojo27's posts yet. But you can encourage our curation team to review posts by visiting them regularly and by referring other readers. Because we give priority to frequently read content.

More Posts From Ojowayne